Cancer dey cause major wahala and pains for plenty people for obodo Naija. Plenty efforts dey go on to tackle di moster called cancer. On 55th episode of TalkingHealthwithDrLaz, TalkHealth9ja bin apply di principles of Solutions Journalism and talked with 4 ogbonge people wey dey lead efforts to defeat cancer.
Talking about wetin dem don do, oga Presido of Naija Cancer Society, Dr. Adamu Alhassan Umar talk say dem dey engage government to make sure say universal health coverage become reality so that people with cancer no go dey sell their property or beg money to treat themselves. ‘Pinky Prof’ Ifeoma Okoye wey be founder of Breast Without Spot and Radiologist for University of Nigeria Teaching Hospital (UNTH) talk say dem dey jinja to rid obodo Naija of late detection of cancer. Mrs Mojisola Animasaun wey be founder of St. Cyril Cancer Treatment Foundation say dem don screen over 1000 women for cancer, create awareness and reduce di burden of treatment on patients. Kolapo Fapohunda na Publicity Secretary, Healthcare Federation of Nigeria (HFN) and he talk say his organisatioon helped to make ogbonge government to budget of NN1 billion in 202 and 2021 for Cancer Health Fund.
Abeg watch di video below make you hear dem direct!
This na Solution Journalism (SoJo) tori wey TalkHealth9ja do to showcase progress on top cervical cancer prevention for obodo Naija. Na Nigeria Health Watch and Solutions Journalism Network (SJN) bin jinja us to do am. We show am for our #TalkingHealthwithDrLaz TV show on Africa Independent Television (AIT).