Di people of Amenu village in Okposi, Ohaozara LGA of Ebonyi State still dey get jerking of mind anytime dem see soldier motor. This na because of wetin dem see or hear on Monday, 31st May 2021. According to Chief Amos Nwonu – the Chairmo of di village, soldiers bin go di only health centre for di village shoot guns like action film, drag out a patient wey dey receive treatment and kill am inside the health center. Chief Nwonu talk say na small thing remain make dem kill di owner of di private clinic and her husband. Say di matter still put them in shock for di village.
Di chief yan all dis tori to TalkHealth9ja team wey go sensitize him and Amenu Okposi Health Committee on wetin dem suppose dey do to make primary health care dey work kajadly for their side. He say fear no go allow health people to treat people with gunshot injuries despite wetin law talk because of di soldiers attack. Tori we gather reveal say na suspected member of Eastern Security Network wey bin run during fight with soldiers on Biafra Remembrance Day dem go allegedly kill like that for di health center.

Di oga of TalkHealth9ja, Dr. Laz Eze condemned di killing of a patient inside a health centre and harassment of di health workers. He say soldiers no suppose use their work to scatter or threaten health worker wey laws cover to save lives first in emergency situations. He gave di village chief some health policy documents wey contain how dem go help make health care pure for their village.