Dr. Joy Adesina scatter every record for di medical school of Obafemi Awolowo University, Ile-Ife. She chop 10 distinctions and carry broom sweep 9 awards pack am into her bag. Plenty Naija people dey give am tuale with chants of “she deserves plenty accolades”.
Doctors Save a Life Foundation don sama dis doctor three million naira award to celebrate her achievement. Di oga for di foundation, Dr. Richard Okoye talk say na their way of celebrating excellence. He advised Dr. Adesina make she use di money join to pursue her dreams, but make she no forget kontri wey make am. She alsp beg am to help increase Naija life expectancy from 54 years to 70 years by 2025.
You fit watch di video of di N3m award presentation here https://fb.watch/9SQbtUdY5j/.