Home Tori From Communities We Go Use Our Town Hall Start Health Post – Amaogudu Ugwulangwu...

We Go Use Our Town Hall Start Health Post – Amaogudu Ugwulangwu Leaders

425
0

Tuesday, 24th November 2021 na day wey di leaders of Amaogudu Village in Ugwulangwu, Ohaozara LGA of Ebonyi State no go forget quick. Na di day wey TalkHealth9ja and Ebonyi State MakeOurHospitalWork Campaign teams land for their domot and teach them about different primary health care policies and responsibilities of Village Health Committees. Na Dr. Laz Ude Eze wey be TalkHealth9ja Oga and Convener of MakeOurHospitalWork Campaign for obodo Naija lead im people do di waka.

Na more than 50 community leaders and women attend the sensitization meeting. After 3 hours of learning, di people of Amaogudu decide say dem go use di 2 rooms inside their townhall to start health post by February 2022. They also promise to increase dem jinja and complete the building of a health clinic for their domot.

Dr. Eze collect kola from Amaogudu Health Committee Chairman

TalkHealth9ja promised to use support im dey get from OSIWA and other partners to help Amaogudu to achieve their health goals.

Other people wey join Dr. Eze do di waka na Damian Omogo, Chinagorom Daniel and Okechukwu Okereke.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.