Home MakeOurHospitalWork Okposi People Jinja to Make their General Hospital Kajadly Kajad

Okposi People Jinja to Make their General Hospital Kajadly Kajad

754
0

The people of Okposi in Ohaozara LGA of Ebonyi State don dey jinja to make the Okposi General Hospital kajadly kajad. In a Facebook post on the MakeOurHospitalWork Campaign page, di Okposi team lead, Mr. Raphael Okereke posted photos of how di community provided tap water inside di wards, clinics, lab, and doctors quarters of di hospital. He carry praise and tuale give groups like Okposi e8 and Okposi Development Forum.

Testing testing of water by Okposi MakeOurHospitalWork Team Lead, Raphael Okereke (right) and Onyebuchi Ude (Uncle Maths)

In same vein, Oga Presido of Okposi e8 (a group of Okposi people wey dey promote unity and development of di community) Elder Emenike Okorie hailed di Okposi Works and Health Committees wey supervise di project for di hospital. According to his message wey reach our domot, he said na N783, 650 dem spend on di tap water reticulation. He listed other things wey Okposi people wan do to make di General Hospital pure. According to how he take write am, “with the completion of the water reticulation phase, we have made a giant leap towards our ultimate destination to rehabilitate the Okposi General Hospital for the benefit of our people. We shall move forward with repairs of some broken facilities, replacement of all wooden doors, and construction of access ramps (for wheelchair access). Then, hopefully, we shall also provide electricity to the hospital through solar power”.

Tap water don dey outside di ward for use by visitors.

He kom list names of 18 people wey contribute di money dem dey use for di project. They include di presido himself – Elder EJ Okorie, Hon Benard Akoma, Anayo M. Okorie, Emeka Edeh, Engr Aja Chima, Chief JC Agwu, Mrs Ngozi Emenike-Okorie, Uchenna Ede, Prof P-J Ezeh, Engr Concord Enyi, Uchenna I. Igwe, Late Rev John Okorie, Elder Omoke Njoku, Dr Laz Ude Eze, Sq Ldr A. Okoro, Barr Chima Agwu, Chief Aja Enyi and Prof. Uzoma Agwu.

Pharmacy department of Okposi General Hospital

According to our torchlightment, Okposi people bin contribute moni to build police station but no kom use am after state government build am. After di Okposi MakeOurHospitalWork Campaign publish Wish List wey show plenty things di hospital dey lack, many big men and women of the community chook mouth for di mata. Former DVC for Alex Ekwueme Federal University, Prof. Philip Omoke na one of those wey carry am for head so tey he drag Commissioner for Health go di hospital. Na from there di people wey donate money for police station say make dem use am fix some things inside di hospital. We go dey follow up with dis tori of progress inside Okposi.

Hospital Ward with no ramp for trolley or wheel chairs.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.