Heart surgeons wey medical people dey call cardiothoracic surgeons na specialist doctors wey fit open human beings chest and do operations for heart, lungs and other organs wey dey there. Inside West Africa, that area be like “Men Only” until Dr. Ogadimma Adannaya Mgbajah scatter di ceiling about 5 years ago.
Dis ogbonge doctor na graduate of di University of Ibadan College of Medicine since 2005. She don grant plenty interviews since she break that record to explain wetin give am jinja. Congratulobia ogbonge Dr. Mgbajah!