Di Oga Presido of Naija Medical Association, Prof. Innocent Ujah mni, yan say doctors for obodo Naija no need anybody’s permission or police report to treat anybody wey get health emergency or gunshot injury. Prof. Ujah talk dis one inside Channels Tv Sunrise Daily wey our tori pesin monitor today.
He also talk say everybody for Naija suppose get health insurance to make am easy for hospitals to treat emergencies and get money dem go use dey maintain emergency care.
For di same interview, Lawyer Femi Aborisade talk say, although no law dey support police report or payment of deposit before treatment of emergency, e no go work well if government no fund hospitals enough to buy things dem go dey use treat people.
NMA Presido talk say Naija government need to set up Bank of Health, just as Bank of Industry and Bank of Agriculture dey.