As di strike of di Nigerian Association of Resident Doctors enter Day 44, no be small vexation dey among di doctors for we kontri. Some of them for inside dem Facebook page dey blast Naija Medical Association (NMA) Presido, Prof. Innocent Ujah say he wan make dem “call off” strike for nothing. One Dr. Patrick Ogbonnaya list dem mata wey government never solve before im blast “Prof. Ujah and his boys”. See as he take post am below:
Plenty other doctors wey comment for di post no show mercy for dia Presido. See dem reactions.
But One Dr. Josef Ameh squeeze face say e no pure for doctors to dey drag office of dem presido inside potopoto because government dey misbehave on top dem mata. But im colleagues no gree with am sha.
As things be, nobody sabi when di resident doctors strike fit end, as di vex wey dey doctors bodi fit cook beans o.
[…] Doctors begin strike and plenty disagreements still dey among medicos over di matter. Di doctor wey blast NMA Presido say im dey mad because of he wan make strike stop when government never settle any dem demand, don kneel for […]
[…] Before his latest post, Dr. Ogbonnaya bin dey receive flowers and tuale from his colleagues when he called Prof. Ujah a mad man for allegedly telling NARD to stop strike. But his colleagues dey vex for am seriously after he […]