Dr. Daniel Umezurike wey be the Ebonyi State Commissioner for Health dey urge di TalkHealth9ja team make dem use dem radio show to support all di beta beta work di Government of Ebonyi State under leadership of Engr. David Nweze Umahi dey do for health sector. He talk dis one when di Oga of TalkHealth9ja Real Media Limited, Dr. Laz Ude Eze led a 3 pesin team to pay am courtesy visit. Mr. Chukwunonso Umeh wey be consultant to TalkHealth9ja and Pharm. Mrs. Jane Enyinnaya wey be Ebonyi State MakeOurHospitalWork Campaign Team Lead follow do the waka.
Dr. Umezurike bin list plenty achievements wey government don do for health in Ebonyi State to include fencing of general hospitals, building of Virology Centre, building of new teaching hospital and university of medical sciences, buying of hospital equipment, and making of 171 health centers make e dey work gidigba. He say no government fit do every thing but say im government dey try no be small. He also talk say make dem no use di show abuse government because dem no go take am easy.
For im own talk, Dr. Eze give gbosa to government for wetin dem don do so far inside health sector and encourage dem to do more to make hospitals dey work kajadly. He talk say TalkHealth9ja Radio Show go help to create better awareness about health issues, and jinja people and communities make dem play active part for primary health care. He promise say TalkHealth9ja go dey professional and say di show dey open to government and people of Ebonyi to talk dem mind.
Mr. Umeh also talk say di show go provide opportunity make government hear more from Ebonyi people and know how their health be. Mrs Enyinnaya also talk how MakeOurHospitalWork Campaign go help jinja communities make dem support government efforts and protect investments in hospitals.
Di TalkHealth9ja Radio Show go start inside Unity 101.5 FM Abakaliki from Thursday 2nd September 2021 and e go dey happen 5 to 6pm every Thursday. Na Open Society Initiative for West, OSIWA dey behind dey support di show.