Home Things wey happen We Go Give Naija Cancer Patients wey no Get Moni free Treatment...

We Go Give Naija Cancer Patients wey no Get Moni free Treatment wey Reach N2m – Ogbonge Govt.

760
0
Dr Osagie Ehanire: Naija Bodi-mata Minister

Naija people, good news dey town for people wey dey fight cancer. Ogbonge government talk say dem go sponsor better treatment of people with breast cancer, cervical cancer or prostate cancer wey no get moni to treat themselves. According by dị tori wey Dr. Uche Nwokwu komot on behalf of Naija Cancer Control Programme (NCCP), dị free treatment fit reach N2 million. Di treatment na for operation, drugs (chemotherapy) or photo wey dey kill cancer (radiotherapy). Dem talk say na only people wey meet di criteria go get dis free treatment. Wetin be di criteria? Dem no talk am. But we go torchlight di mata and bring di tori to you.

Na only 6 hospitals inside Naija dis free cancer treatment fit happen o. See di list down below:

  1. National Hospital,Abuja
  2. UNTH ENUGU
  3. UCH IBADAN
  4. ABUTH Zaria
  5. FTH Gombe
  6. UBTH Benin

Dem say anybody wey wan apply make e follow dis link https://chf.emgeresources.com.

See photos wey carry di full tori.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.