As people still dey para against United Kingdom (UK) about their new rule wey talk say people wey take Covid19 vaccination for obodo Naija go park one side for 10 days if dem enter obodo oyinbo UK, dem don komot another tori.
Dem post their new tori for Twitter, wey talk say Naija go enter “rest of the world” list wey go get “simplified travel measures” from 4th October 2021. Dem no explanate wetin this “simplified travel measures” mean.
See their new tori below.

Some Naija people dey reply for twitter say make UK government break am down because dem don tire to dey suffer discrimination.

We go dey follow up on this matter wey concern Covid19 vaccination and international waka. Make you dey watch our television show too, TalkingHealthwithDrLaz on AIT every Tuesday 6.30pm.