September 19 every year na International Snake Bite Awareness Day (ISBAD). When ogbonge Ministry of Health dey mark this day for 2021, junior Minister for Bodi-mata, Senator Olorunnimbe Mamora talk say snakes dey vex bite average of 20, 000 people for we kontri every year. He also talk say this biting of snake dey kill about 2000 people every year and cutting of legs of people wey reach 1,700.
Oga Minister Mamora say na the Carpet Viper dey bite people pass, like 9 out of 10 people wey suffer snakebite. Also, out of every 10 people wey die from snakebite, 6 na from the bite of carpet viper.
If you wan read more about dis tori, click here.