Home Aluta Tori Resident Doctor dey inside Frying Pan for Hailing NMA Presido

Resident Doctor dey inside Frying Pan for Hailing NMA Presido

997
0

No be small bashing Dr. Patrick Ogbonnaya dey collect from his colleagues inside Facebook since he hailed oga presido of NMA, Prof. Innocent Ujah mni as pesin wey dey “work 100%” for Naija Doctors. Before his latest post, Dr. Ogbonnaya bin dey receive flowers and tuale from his colleagues when he called Prof. Ujah a mad man for allegedly telling NARD to stop strike. But his colleagues dey vex for am seriously after he made U turn begin hail di NMA Presido and even tendered apologia.

Some doctors sama accuse give am say Prof. Ujah go don bribe am to dey talk “rubbish” but say e no go work. Dr. Ogbonnaya no even send di heat on top di frying pan. He say he change his view about NMA Presido after watching his interview on Channels Tv. He tell people wey no like wetin he talk to go and hug transformer.

Prof. Innocent Ujah – NMA Presido.

Professor Ujah dey receive serious criticisms from plenty of Naija doctors wey believe say he no dey protect their interest especially since resident doctors begin strike 54 days ago. Some of them don begin “Ujah must go” Campaign because of di mata. But di Presido never reply our message on how he feel about di complaints against him.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.