Better tori dey for Naija men o. Ogbonge government don give approval today to allow men wey dem wife born new pikin or dem adopt new small pikin stay inside house, pour powder for bodi, follow chop better food and look after dem new pikin and wife for 14 days. Oyinbo dey call am paternity leave. Na Oga Madam of Federal Civil Servants for inside Naija, Dr. Folasade Yemi-Esan follow tori people talk dis one after Federal Executive Council Meeting wey VP Osinbajo head today.
Dem say dis approval na to allow men bond well well with dem pikin, so that pikins no go dey look dem papa anya anya like stranger when dem return from work. Na only men wey dey federal civil service go fit enjoy this new policy, but states and private people fit do the same thing for them men.