Home Aluta Tori #AsEdeyHot: Naija Resident Doctors Get New Leaders as Strike Continua

#AsEdeyHot: Naija Resident Doctors Get New Leaders as Strike Continua

925
0

Di Nigerian Association of Resident Doctors, NARD, don get new national Presido in the pesin of Dr. Dare Godiya Ishaya wey dey work for Abubakar Tafawa Balewa University Teaching Hospital in Bauchi. Dr. Orji Innocent from FMC Umuahia na di new Crown Prince, meaning na him go become Presido by September 2022. Other excos na 1st VP – Dr Edoga Chima, 2nd VP – Dr Buba Babangida and Secretary-General – Dr Suleiman Abiodun Isma’il.

Tear-rubber 2021/2022 NARD Excos taking oath

According by the informate wey reach us from trusted quarters, many members believe say di new presido go continue with the struggle to make government treat residents well. All the members we follow talk give plenty gbosa to the Presido wey just komot from chair, Dr. Uyilawa Okhuaihesuyi.

NARD bin start strike on 2nd August 2021 with plenty complain and their fight with government never settle.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.