Home Things wey happen Strike: No Work No Pay, I No Go Follow Doctors Talk Again...

Strike: No Work No Pay, I No Go Follow Doctors Talk Again – Ngige

500
0
Dr Chris Ngige - Minister for Jobs Mata

Today na 6th day since resident doctors all over obodo Naija begin stay home say ogbonge government no dey keep their agreement. And no be small vex dey di body of Dr. Chris Ngige wey be Minister for Jobs matter. He talk say na “no work no pay” levels di matter don reach. Na for Channels TV Politics Today he talk am. He also talk say he no go meet or follow di doctors talk again because dem no dey hear word.

“I won’t meet them anymore because I have other things to do. I did two conciliation yesterday. Am I going to be wasting my time with them?” – Na so Dr. Ngige blow di grammar on TV.

As these two elephants dey do roforofo fight, na so patients dey suffer like grass. How you see dis mata?

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.