As siddon for house strike of di Nigerian Association of Resident Doctors (NARD) enter 7th day, di Presido, Dr. Uyilawa Okhuaihesuyi dey demand make three senior officials of ogbonge government komot from chair with immediate alacrity. Di officials wey dem say are “stumbling blocks” to peace and progress of our health sector na Dr. Chris Ngige (Minister of Jobs mata), Dr. Osagie Ehanire (Minister of Bodi-mata) and Dr Tajudeen Sanusi (Registrar of Medical and Dental Council of Nigeria).
During a phone interview with our tori pesin, Dr. Okhuaihesuyi sama accuse give Dr. Ngige say he dey lie like Lai on top payment of resident doctor and di strike wahala. He also talk say Health Minister dey behave like say welfare of doctors no concern am while Dr. Adebimpe Adebiyi (Director of Hospital Services for Federal Ministry of Bodi-mata) dey talk different things at different times with no better action to implement agreement. As for Dr. Sanusi, he say he say na disaster im be on top mata of placement of house officers and other issues affecting doctors for we kontri. NARD wan make Dr. Adebiyi pack her bag komot for Department of Hospital Services.
Di NARD Presido go show face for TalkingHealthwithDrLaz on Africa Independent Television by 6.30pm this Tuesday, 10th August 2021 to talk more about the strike and other issues.