Di oga Director General for di Naija Centre for Disease Control (NCDC), Dr. Chikwe Ihekweazu go port go World Health Organization (WHO) from November 2021 as di Assistant Director-General for Health Emergency Intelligence.
We confirmate dis tori from mail wey WHO oga bin send to dem dia staff wey reach our domot. Some Naija health experts dey respond say e dey sweet and pain dem at same time because of plenty better work Dr. Ihekweazu dey do for NCDC.