Dr Obinna Ossai wey be the founder of contra health scam.com show face for our TalkingHealthwithDrLaz TV program. Him talk say e get many ways people dey take collect wuru wuru moni on top health matter, di first one wey him throw give us nah weight loss products like waist trainers( dat tin wey women dey take tie belle) and slimming tea. He talk say all of us wey dey use waist trainer find coke bottle shape just de throway moni, no be say nah bad thing to wear am to sample fine body inside cloth but to wear am take comot big belle NO GO WORK.
The solution wey him give nah the same solution plenty people don know tey tey, Dr Obinna say the ogbonge way to lose weight nah to dey look di kind food wey pesin dey put inside mouth and to dey do exercise.
Una neva hear am finish o! You fit watch dis video below wey go tell you oda things wey fit helep you dodge health wuru wuru and wayo things.