Home Charity Tori Anambra Dey Jolly as Sen. Ifeanyi Ubah, Ibeto and 358 others build...

Anambra Dey Jolly as Sen. Ifeanyi Ubah, Ibeto and 358 others build Hospital Blocks inside Unizik, NAUTH.

508
0

Since 2020, coronavirus pandemic don show people inside obodo world shege including ndị Anambra. But e take style bring blessing to them. Coro pandemic be like breeze wey open dị nyash of health sector inside Anambra say e no try at all because of plenty neglect. As shame dey catch plenty leaders for obodo Naija, Senator Ifeanyi Ubah say he must clear some shame komot for Anambra. Na so he carry phone begin call im friends wey dey like better thing. Na so dem form Anambra Progressives Development Union, 360 big men contribute plenty moni build hospital blocks inside Nnamdi Azikiwe University Awka and dem teaching hospital (NAUTH) for Nnewi.

Unizik Medical Centre Wards Complex donated by APDU

With the spirit of Make Our Hospital Work Campaign, TalkHealth9ja go Anambra to torchlight whether dị tori about these hospitals wey dey social media na true. We use our legs go Awka and Nnewi to see korokoro. We hear day dem dey build another one for Onitsha wey dem never finish but we no reach there.

As we go NAUTH, plenty people full inside dị tear rubber building Sen. Ubah and friends bin donate last year, wey dem dey use am as Medical Out-patient Clinic (MOPD) for treatment. Dem get 8 consulting rooms wey doctors dey gidigba.

We also saw dị fine hospital building with fine wards wey dem donate to Unizik for Awka. Na part of the University Medical Centre.

For dị 2 hospitals, dem write the names of all di better people wey contribute money for the building. Anambra people wey follow us talk dey jollificate and bin give plenty tuale and gbosa to Sen. Ubah and all im friends for dị project.

NAUTH Medical Out-patients Department donated by the Anambra Progressives convened by Sen. Ubah

This one na correct tori but e get plenty other things we see about health sector for Anambra wey no sweet belle at all. We go serve you dị tori.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.