On Monday 31st May 2021, di Ebonyi State government bin announce Prof. Jesse Uneke as pesin we go dey act as di Vice Chancellor of di tear-rubber King David University of Medical Sciences Uburu in Ohaozara LGA. According by di statement wey Kenneth Ugbala di Seke of di State komot, Prof. Uneke appointment na only for 6 months but dem fit give am extension or make am permanent.
Plenty reactions by Ebonyi people don follow dis appointment inside social media. Plenty people dey shout say na scam e be because Governor David Umahi begin build di school as Ebonyi State University College of Medicine and teaching hospital. Dem wonder when e begin dey answer King David. Some dey suspect say di governor wan use ojoro convert am to im own. Some allege say na TETFUND wey belong to EBSU dem use build am. But di supporters of di governor dey hail am like say tomorrow no dey.
Inside facebook post by Oganihu Ebonyi wey dem ask “Ndị Èbọ̀nyị̀,
The proposed EBSU Teaching Hospital Uburu is now King David University of Medical Sciences Uburu. How una see am?“, plenty people talk their mind for there o. Look some of dem comments below;