Today, pipo all over obodo world dey mark today 28th May as world Menstrual Hygiene Day. This day na for di promote of better cleaning of blood wey dey flow during woman period. The reason wey make the world dey recognize this day na to take stop the anyhow behaviour twoards women (stigma) wey dey see dem period. Dem choose 28/5 because for many women dey see dem period every 28 days (menstrual cycle) and di flow dey take up to 5 days for most women.
To celebrate dis day, ogbonge bodi mata sabinus and TalkHealth9ja oga, Dr Laz Eze talk say young girls need plenty support to make sure dem period dey clean. He talk dis one for im post inside twitter.
The theme for this year na ‘’Action and Investment in Menstrual Hygiene
and Health’’