Beta tori dey for town o. TalkHealth9ja don join di Solutions Journalism Africa Initiative (SJAI) to train dem journalists and increase dia jinja to produce tori wey go helep solve plenty problems for obodo Naija. Na Solutions Journalism Network wey dey New York, USA and Nigeria Health Watch for Naija join hands dey implement di initiative for we kontri.
Both TalkHealth9ja and Nigeria Health Watch don put hand for paper sign contract on Tuesday, 11th May 2021. Dem yan say dem go work together as partners inside dis project. Na our oga, Dr Laz Eze sign for TalkHealth9ja while di Finance & Admin Manager for Nigeria Health Watch, Mr. Nnaji sign on dem behalf.

TalkHelth9ja follow for di first 10 media organisations wey join dis initiative. Other media organisations wey follow na This Day Newspapers, News Agency of Nigeria, Daily Trust Newspaper, Nigeria Info FM Abuja, etc. Dem go receive training and jinja to do correct “solutions” tori. According by di Naija Project Manager, Mr Chibuike Alagboso, talk say na because of di correctness of TalkingHealthwithDrLaz TV show and di kajadness of di Pidgin English blog make dem select TalkHealth9ja for di project wey go last for 8 months.