Look some things wey you suppose know about hypertension.
- Hypertension na wetin we dey call high blood pressure or high BP. Na BP of 140/90 mmHg and above. Normal BP na between 90/60 to 120/80mmHg.
- Hypertension dey easy to find out for pesin body and e no dey fear face.
- Majority of cases, we no know di cause of hypertension.
- Drugs dey for di treatment, but e fit cost for people wey no too get moni.
- Hypertension wey dem no treat fit kill papa, mama even young pesin join.
- According by ogbonge torchlightment of sabinus scientists dem, use of excess salt, too-big body weight, smoking and alcohol fit increase the risk of hypertension.
- Uncontrollable high blood pressure fit cause stroke and heart disease.
- Dey avoid too much salt
- Dey reduce intake of alcohol or ogogoro.
- Dey exercise or move your body everyday
Remember say life no get duplicate. Dey check your body with a medical doctor regularly!