Home Talking Health with Dr Laz #WorldMalariaDay2021: Coro Dey Kill But Malaria Na Master Killer!

#WorldMalariaDay2021: Coro Dey Kill But Malaria Na Master Killer!

461
0

As obodo world marked di World Malaria Day on 25th April 2021, mata of malaria don get attention again since coro pursue am from news lst year. Malaria na one of di sickness wey don kpai pipo pass any other nyama
nyama sickness for we obodo naija. According by WHO, malaria dey kill
more than 400,000 pipo every year. Di major pipo wey dis master killer
dey use chop large na children wey never reach 5 years and pregnant women.

Ontop  di talk-talk bodi mata show #TalkingHealthWithDrLaz, other bodi mata sabinus  join di ogbonge Dr Laz Eze on the show to take yarn how  naija go take pursue malaria komot for we country make pipo for no continue to dey die like fowl. Di two guests ontop di show na Dr. Perpetual Uhomoibhi wey be Oga Madam for di National Malaria Elimination Programme (NMEP) and Odinaka Kingsley Obeta – Medical Laboratory Scientist and Zero Malaria Youth Champion. According by Dr.
Uhomoibhi, naija never get any vaccine for malaria.

Watch the video for here make you take hear other informate wey dem tori
for di show.

Dr Laz, Mr Obeta & Maazi Ogbonnaya during di show

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.