No be small jollification dey inside University of Chicago for obodo oyinbo United States, obodo Naija and many parts of di world as ogbonge medical doctor and expert for torchlightment of cancer mata – Dr Olufunmilayo Olopade gets elected to National Academy of Science for America. Na University of Chicago where she be di Director of Centre of Global Health komot dis tori for dem website on 27th April 2021.
Dis award-winning Naija woman wey bin study medicine for University of Ibadan College of Medicine and don win plenty awards and grants inside obodo oyinbo America on top cancer research. Dis award na one of di highest awards wey any scientist fit get.
Click here for more informate.