Home As e de hot We See Danger! Yawa fit ghast for Naija Health Sector Soon –...

We See Danger! Yawa fit ghast for Naija Health Sector Soon – Resident Doctors

710
2

E be like say Naija health sector don become mata of one day one trouble! If no be patients complain of i-don-care attitude of some health workers for health centres and hospitals, e go be fight among health workers themselves or even fight between bodi-mata workers and government.

On 7th of March 2021, di National Association of Resident Doctors bin write letter to di ogbonge minister for bodi-mata, Dr Osaghie Ehanire where dem raise alarm say na only danger dem dey see for we health sector. Dem vex say ogbonge government never keep all di agreement dem reach with dem in April 2020. Dem complain say plenty resident doctors never receive allowee, or even salaries. Dem also squeeze face on top non-payment of 50% Coro hazard allowance wey dem dey accuse govt of. Di complains plenty sha…

look below make you see di letter wey dem post for dem twitter post make kontri people hear dem voice before kasala go burst. Remember our tori say resident doctors for UCH Ibadan dey do 5 days warning strike wey go end tomorrow because of same reasons.

2 COMMENTS

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here