Di Association of Resident Doctors (ARD) inside University College Hospital (UCH) Ibadan yan say dem no go work from today reach Friday dis week because di hospital dey owe 370 of dem members salary for 2 months. Dem also dey vex say dem never add 230 of dem members for IPPIS wey be computer wey dem dey use pay salary. Na inside their twitter dem make dis post today. Dem talk say dis strike na first warning im be.
Our torchlightment show say dis same problem dey for many teaching hospitals for obodo Naija. Say many doctors especially house officers never see alert since January dis year. Di National Association of Resident Doctors (NARD) bin do meeting with ogbonge govt on top dis mata and raise hope say dem go solve di problem. As things be, e be like say water don dey pass garri for dis mata.
[…] hear dem voice before kasala go burst. Remember our tori say resident doctors for UCH Ibadan dey do 5 days warning strike wey go end tomorrow because of same […]