Better tori dey for town o! Our oga for TalkHealth9ja wey be sabinus on top medicine and public health things, Dr. Laz Eze na di pesin wey di University of Kentucky (UK) College of Public Health (CPH) for America send im name to di university as one of those dem go consider for di Alumni Global Impact Award. Dis award na for people wey graduate from University of Kentucky wey use dem profession and jinja dey do plenty betterments wey dey affect di life of people.
See di notice wey di Alumni Coordinator Jillian Faith bin send to Dr Laz; “Hi Laz! The UK College of Public Health would like to nominate you for the University of Kentucky “UK Alumni Global Impact” award. We believe you are most deserving of the award!”. As Oga Laz give dem carry go, na so dem carry im name and CV submit to di University. According by di torchlightment wey we do, University of Kentucky go announce di winners latest by April or May 2021.

Dr. Laz Eze bin collect Master of Public Health degree (Health Policy and Management) and Graduate Certificate in Global Health with distinctions and plenty other awards from di university in May 2013. Also, na im be di oga presido of all di students wey dey study public health inside di university in 2012. Dem call dem University of Kentucky Student Public Health Association (UKSPHA).