As coro vaccines dey land obodo Naija on Tuesday 2nd March 2021, di National Primary Health Care Development Agency (NPHCDA) don komot website wey Naija people especially bodi-mata workers go register. Click here https://www.nphcdaict.com.ng/publicreg/ if you wan register yourself.
Di NPHCDA don komot wetin dem call T.E.A.C.H Strategy to use make sure di giving of vaccines go jejely. See wetin e mean below;
•T: Traditional Vaccination Campaign Roll-out
•E: Electronic Self-Registration by Eligible Nigerians
•A: Assisted Electronic Registration of Eligible Nigerians
•C: Concomitant Vaccination alongside Electronic Registration
•H: House-to-House Electronic Registration