Home As e de hot “Man Wey Work Suppose Chop!” – Hospital Interns Scream as dem begin...

“Man Wey Work Suppose Chop!” – Hospital Interns Scream as dem begin We-no-go-gree Waka over 3 months of No Salary

995
0

Serious vexation dey for many big government hospitals for obodo Naija as di matter of no payment of health workers still dey on. 3 weeks after di National Association of Resident Doctors (NARD) talk say dem bin see danger and yawa for we health sector because of no payment of salaries, tear-rubber doctors (House Officers), nurses, pharmacists and medical laboratory scientists, wey oyinbo call interns, don begin we-no-go-gree waka for different hospitals for we kontri.

For inside social media, our tori pesin saw video of House Officers for Jos University Teaching Hospital wey dem dey beg for di payment of dem salary for 3 months. Another video wey Nursing World post inside twitter show other interns for Uniabuja Teaching Hospital Gwagwalada wey dey do vexation waka on top no payment of salaries. Plenty Naija people don dey paravex, dey balst government for wetin dem call “wickedness of the highest order” against the young doctors.

We go follow up dis mata.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.