For inside the 25th episode of the number one ogbonge bodi mata talk
show #TalkingHealthwithDrLaz, sabi people don open our eyes to why e dey importamkpa for we kontri to support industries wey dey produce drugs and medical products inside Naija. Di guest speakers wey join Dr. Laz for di talk talk show na Frank Muonemeh di Seke for PMG-MAN and Okwudili Egwu, Senior Vice Presidoo for Cowry Asset Management Limited.
Dem torchlight di ways wey we government go take helep the industries wey dey produce drug for we country to take dey kajadly kajad and produce our drugs to take safe we country the plenty moni wey we dey take buy drugs from obodo oyibo.
Watch the full video for here;