Home Things wey happen Tear-rubber NGO – Natasha Ilo Foundation to Helep Improve Health of Pikins

Tear-rubber NGO – Natasha Ilo Foundation to Helep Improve Health of Pikins

440
0

A tear rubber NGO wey just show face on 23rd February 2021, Natasha Ilo Foundation go help promote better health for small pikins dem, feeding of pikins and fight violence and by-force miniminiwanawana against women. E go also promote education especially of girl pikin dem.

Di Oga of Open Society Initiative for West Africa (OSIWA) inside Nigeria, Mr. Udo Jude Ilo talk dis one during di opening of di NGO inside Abuja. Di launch of di NGO happen along with the launch of Kasie – a book of poems he wrote as he dey mourn the death of im beloved daughter – Natasha some years ago. Di event gather pipo from all around the world including Vice President Yemi Osinbajo, b4 b4 presido Goodluck Jonathan. We sef wey be TalkHealth9ja crew been dey there to cover the event and see things for wesef.

Natasha Ilo na di second daughter of Oga Jude and Nkem Ilo wey water swallow for inside swimming pool and she die 5 years ago. We join everybody dey tell im family pelenu pelenu.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.