Serious accuse don dey on top di head of di Ebonyi State Commissioner for Health, Dr. Daniel Umezurike on how dem take do shutdown and takeover of di Presbyterian Joint Hospital Uburu in Ohaozara LGA of di state. We follow eleven before before staff of di hospital talk between December 2020 and February 2021. No be small vex dey dem bodi. All of dem no wan make we use dem name, dem dey fear say government pipo fit use thugs wunjure dem.
According by di tori wey we gather from di former staff dem, one govt pesin carry letter of quit notice go di hospital for Sunday night of 6th September 2020, make dem pack their kaya komot because state government wan take over di hospital. On Monday 7th September 2020, di commissioner carry thugs wey squeeze face with big akpu obi and red eyes land for di hospital tell everybody to vamoose. Before dem say Mama Peace, di thugs pursue all of dem within 2 hours. All di doctors, nurses, cleaners, plus every staff wey dey duty pack dem kaya komot.
We bin ask di commissioner about dis mata make he fit talk im side of di tori but he no answer us. We send am di questions via WhatsApp message on Monday 22nd February 2021, di status show say e deliver and he don read am by 2.38pm. Anytime wey he change im mind answer us, we go talk im side of di tori.
From di torchlightment wey we do, some people of Uburu wey be di home town of di commissioner plus including Gov. David Umahi of Ebonyi State talk say di 100 years wey dem give di church land for hospital don expire and dem want am back. Presbyterian Church talk say no be community give dem land, say dem still dey settle di families wey give Church of Scotland Mission land for 1912. Di tori long sha, you fit read am for thesightnews.com.
Wetin happen to di patients wey dey inside hospital? Wetin happen to di more than 170 people wey be workers for di hospital? Wetin happen to di money wey di accountant don collect that day? Wetin Ebonyi State Government carry di hospital dey do now? How di by-force closure take dey affect treatment of sick people for Ohaozara, Onicha, Ivo and Afikpo North LGAs (Ebonyi), Aninri and Nkanu East LGAs (Enugu) wey dey use di hospital well well? Plenty talk still dey dis mata. We go dey release di informate small small.
[…] remember dis tori wey we publish this week – “Shock! Ebonyi Health Commissioner bin carry Thugs Pursue Us Komot from Hospital – Former PJH Uburu…“, onyokometer don do torchlightment find out some new tori wey follow am. Di b4 b4 […]