Di administration of Governor David Umahi of Ebonyi State carry big eye dey build a tear rubber ogbonge university teaching hospital and college of medicine inside Uburu for Ohaozara LGA of di state. Di Ogbonge Government of Naija (FG) bin take over di before before Ebonyi State University Teaching Hospital Abakaliki (EBSUTH) join di Federal Medical Centre Abakaliki to form di Federal Teaching Hospital Abakaliki (FETHA). Im name don change to Alex Ekwueme Federal University Teaching Hospital Abakaliki (AEFUTHA) as di Alex Ekwueme University Ndufu Alike Ikwo (AE-FUNAI) na di new owner and dem don begin dey train medical students. From wetin our tori pesin hear, di new hospital fit ready dis year.
See photos of di hospital wey Ebonyi Government officials and APC people bin post on top social media.


