Home Onyokometa #Onyokometer: Nurses Wey Ebonyi Govt Employ for Health Centres No Dey Go...

#Onyokometer: Nurses Wey Ebonyi Govt Employ for Health Centres No Dey Go Work 6 Months After

416
0

Our onyokometer wey dey torchlight things we dey happen for inside health sector for we kontri don find some things wey dey worry inside Ebonyi State health sector. Di new nurses and midwives wey Ebonyi State Ministry of Health bin hire in 2020 to dey work for primary health care centres across di state dey receive only alert but dem no dey do di job. Our tori people bin visit some health centres inside Ohaozara, Afikpo North, Ezza South and Abakaliki, di story na di same.

One senior health official wey no wan make we talk im name yan us say na because politicians for Ebonyi cause am. Dem say instead make dem employ nurses wey wan work, dem carry di job share to dem their family members and girl friends plus those wey still be nursing students. Even inside di LGA of Gov. Umahi, na same tori, none of di 22 new nurses dem post there bin dey work when our people take style show face inside di health centres. We hear say some of dem dey pay 5k bribe every month to di CHEW wey be in-charge of di health centre so dem no go dey show face for work. Na di federal government moni of Basic Health Care Provision Fund dem use hire these nurses wey no gree dey go work o.

Ebonyi State government, make una torchlight dis matter o before water go pass garri.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.