Di Okposi chapter of di Make Our Hospital Work Campaign for inside Ebonyi State don give plenty tuale to di Government of Ebonyi State, say dem supply new medical equipment to General Hospital Okposi. According by di statement wey dem Oga Team Lead, Mr. Raphael Ogbonnaya Okereke komot, dem list all di new equipment wey di state supply for December 2020. Dem say e sweet dem belle say di government buy di equipment but dem beg di government say make dem employ health workers wey go dey use di equipment work and save lives.
Our torchlightment show say no general medical doctor dey work inside di hospital, but na one eye doctor bi di oga for there. Nurses dey only 4, plus 3 other people. We bin confam say di hospital no dey work well because di workers for there no dey too dey for duty.
Di make Our Hospital Work Campaign for Okposi, Ohaozara LGA bin call on traditional rulers, youth them and all people wey matter for di community to make sure say nobody thieve the new equipments. Dem also wan make di state government establish a blood bank for inside di General Hospital before June 2021 go pass.
Make you look di list of di new equipment wey Ebonyi State government send to Okposi General Hospital, according by di statement wey di campaign komot to tori people.
- Hospital beds (50)
- Pillows (50)
- Mattress (50)
- Overbed tables (50)
- Bedside cupboards (50)
- Oxygen cylinder (10)
- Screen (for patient’s privacy) (10)
- Suction machines (10)
- Trolleys (10)
- Tables (10)
- Bed pan (10)
- Stretchers (5)
- Oxygen regulators (10)
- Bed linens (200)
- Plastic chairs (100)
- Digital sphygmomanometer (2)
- Portable autoclave (2)
- Stethoscopes (2)
- Two sets of Gen. Instrument (2)
- Ambu bag (10)
- Couch (1)
Wow! God bless our leaders for the work