Home Uncategorized #Covid19: No Bring Any Vaccine We No Approve into Obodo Naija –...

#Covid19: No Bring Any Vaccine We No Approve into Obodo Naija – NAFDAC

530
0

Di Oga Madam of di National Agency for Food, Drugs Administration and Control (NAFDAC), Professor Mojisola Adeyeye talk say her agency go approve any vaccine including Covid19 vaccines before e go enter obodo Naija. She talk dis one when she follow tori people dey talk inside AIT Kakaaki dis morning. According by Prof. Adeyeye, di Federal Ministry of Health and di National Primary Health Care Development Agency (NPHCDA) get di job of buying and giving vaccine to Naija people; but NAFDAC get di job of torchlighting and giving carry-go before dem go bring di vaccines enter obodo Naija.

She talk say people Naija government don already sign paper say na dem go dey in charge of treating any side effect of Covid19 vaccines. She say because of dis one, NAFDAC must torchlight di vaccines wella, give am passmark if e pass di torchlightment, so dat e no go wunjure kontri people. She say NAFDAC go use “Reliance” method to do sharp sharp torchlightment within 5 years since other agencies like am for some other countries don already torchlight di vaccines.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.