
Di catholic Church for obodo Naija dey cry seriously since di Catholic Secretariat of Nigeria announce that dem before Secretary General, Monsignor Ralph Okechukwu don die. Di tori wey we gather from source wey we trust but no wan make we use im name talk say na Covid19 send di ogbonge priest to im ancestors. We hear say Msgr Madu bin dey receive treatment inside one private hospital before Gov. Hope Uzodimma direct make dem carry am go di “state of the art” Covid19 Isolation and Treatment Centre inside Owerri. Dem carry di reverend with oxygen reach di isolation centre but when dat one finish, no oxygen dey to continue im tretament. Na so dis ogbonge Father take die o. Before im death, na him be di Chaplain of di Imo State Government House Chapel.

Imo Commissioner for Health
We asked di Imo State Commissioner for Health, Dr Damaris Osunkwo through WhatsApp message, whether na true say oxygen no dey for di “ultra-modern, state of the art” Covid19 Isolation Centre inside Owerri. We also asked her whether na true say na Gov. Uzodimma say make dem carry Fr. Madu go di isolation centre, and whether di isolation centre dey function wella. WhatsApp show us say she don read our questions but we still never get answer. As soon as we get her reply, we go update dis tori.