Home As e de hot Una Too Much! MakeOurHospitalWork Campaign Hails Award-Winning Members

Una Too Much! MakeOurHospitalWork Campaign Hails Award-Winning Members

408
0
Runcie Chidebe receiving award from US government

Di Make Our Hospital Work Campaign – group wey dey jinja make health centers and hospitals dey function wella for we kontri, don hail two of im National Strategy Team Members wey win awards. For di message wey dem post inside twitter, di campaign talk say dem dey proud of Mr. Runcie Chidebe wey American Embassy give award and Dr Chinonso Egemba (Aproko Doctor) wey win Impact Africa Summit award for Health Media.

Mr. Chidebe na di nly Naija pesin out of 80 wey American government give di recognition. See as he take announce am inside twitter “U.S. Department of State has honoured me as one of 80 #FacesOfExchange alongside PM, New Zealand @jacindaardern, @UN SG @antonioguterres & other outstanding alumni of @StateIVLP.” He na one of di people wey US govt don sponsor to visit di kontri and learn some kind better things. He dey do plenty things to fight cancer through im NGO – Project Pink Blue.

Dr Chinonso Egemba (Aproko Doctor) as he dey collect Impact Africa Summit Award

Aproko Doctor dey use twitter dey educate kontri people on different different health issues. And he dey do am well well.

We join di Make Our Hospital Work Campaign group and other naija people dey say, Tuale!

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.