Home Covid 19 Ogidigborigbo Disease Wey Pass Covid19 Dey Come – WHO

Ogidigborigbo Disease Wey Pass Covid19 Dey Come – WHO

437
0
Dr Mike Ryan

Di join bodi of bodi-mata for obodo world wey oyinbo call World Health Organisation (WHO) dey warn people of di world and governments make dem shine dem eyes dey prepare well for di prevention and control of diseases. Di Oga for di WHO Emergency Programme, Dr Mike Ryan talk dis one when dem follow tori people do end of the year talk on 28th December. Prof. David Heymann wey be di Chair of WHO Strategic and Technical Advisory Group say e be like say Covid19 destiny na to stay with us and become “endemic”.

WHO talk say covid19 don show people pepper but based on how fragile di world be, a bigger pandemic fit still show face. Them say everybody need to “get our acts together” and wake up to prepare well for ogidigborigbo health emergency because e fit show anytime for obodo world without warning.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.