Home MakeOurHospitalWork #SaveIMSUTH, We No Get Hope Again! Imo State Medicos Cry to Gov....

#SaveIMSUTH, We No Get Hope Again! Imo State Medicos Cry to Gov. Hope Uzodimma after Spending 10 years with No Graduation

621
0
Imo State University Teaching Hospital, Orlu need saviour!

Di Imo State Medical Students Association (IMSUMSA) don dey cry for many months now say dem no get hope again as dem government no send them again. In fact, dem do we-no-go-gree waka inside Owerri and carry dem cry enter social media using the hashtag #SaveIMSUTH. Dem talk say their most senior don spend 10 years and as e be, dem no get hope of when dem go graduate because di school don lose di National University Commission (NUC) to dey train medical doctors.

Di IMSUMSA Presido, Mr. Ekeh McDonald Uchenna follow our tori pesin confam say NUC don withdraw di approval from di school for di training of doctors. He also bin lament say if Gov. Hope Uzodimma no shake bodi, di hospital fit fail di test of Medical and Dental Council of Nigeria (MDCN) wey go happen dis year and loose accreditation. Dis one mean say di hospital no fit graduate medical doctors again.

See di kind messages dem dey messages dem dey post on social media using #SaveIMSUTH.

We dey try reach Imo State Government officials make dem respond to this matter but we never succeed. We go follow up di tori bring you all sides as e dey hot.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.