Home EndSARS The Killing of #EndSARS Protestors dey Pepper We Bodi – Young Medical...

The Killing of #EndSARS Protestors dey Pepper We Bodi – Young Medical Lab Scientists

423
0

As Naija people of every work of life dey condemn police and soja people over di killing of peaceful #EndSARS protesors for Lagos and other parts of obodo Naija, di Young Medical Laboratory Scientists Forum talk say e dey pepper dem too much. Dem talk dis one for si statement wey dem presido, Isomah Chiladi Jeff komot on dem behalf today. The group say di killing dey “unjust, illegal and too scornful to bear”.

Di young medical lab scientists urge dem members for di whole kontri to provide assistance for protestors wey get injuries. Dem presido also tell their members make dem shine their eyes as dem dey do their work.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.