Di Medical Director for di Federal Neuro-Psychiatry Hospital for Calabar, Dr Bassey Edet talk say di thieves and hoodlums wey attack dem hospital show dem Cameroon pepper. He talk dis one for di interview inside AIT “Mood of the Nation” yesterday night. Dr Edet say di hospital wey get capacity to admit 200 patients at a time dey “ground zero” now as dem scatter everything inside come. He talk say many of di patients no run away but everybody dey in pains.
He also say he don yan oga minister for bodi-mata, Dr Osagie Ehanire and dem don dey compile di list of everything wey loss or damage inside di hospital to give ogbonge government.
Read tori about di destruction of health facilities for 8 different states for we kontri here.