Hoodlums, thieves and miscreants wey take over after di end of peaceful #EndSARS protests for di various parts of obodo Naija don show di health sector serious pepper. Tori wey reach us show say dem thief and destroyed things for inside government and private hospitals, medical stores and offices wey dem dey keep drugs and other medical equipment.

Of all di 10 states we don hear dem tori, e be like say na Cross River State wey see di pepper pass, in fact, na cameroon pepper dem see as di looting and destruction hit di 3 biggest hospitals for di state. Dem even pursue patients and carry dem beds inside Federal Neuro-psychiatry Hospital for Calabar. All di drugs inside Kogi Central Medical Store plus including vaccines for immunisation don vamoose, same for Adamawa and NAFDAC Office inside Kaduna.
According to tracking wey we do with informate from online sources, see list of States and health facilities wey bad people attack and loot;
State | Number of facilities attacked | Names of facilities attacked |
Abia | 2 | Abia State Dental Centre, Aba Aba South Health Authority |
Adamawa | 2 | Adamawa State Primary Health Care Development Agency; Adamawa State Central Medical Store, Yola. |
Cross River | 3 | Federal Neuro-Psychiatry Hospital, Calabar. Infectious Disease Hospital, Calabar University of Calabar Teaching Hospital |
Edo | 1 | Central Hospital, Benin |
Imo | 2 | Health Department, Ehime Mbano LGA Ezinihitte LGA Cold Store |
Kaduna | 1 | NAFDAC Office Kaduna |
Kogi | 1 | Central Medical Store, Lokoja |
Lagos | 2 | Lagoon Hospital, Apapa Budo Specialist Hospital, Ajah Lagos |
Ondo | 1 | General Hospital, Igbokoda, Ilaje LGA |
Rivers | 1 | Divine Grace Hospital in Oyigbo, Port Harcourt |

Plenty bodi-mata people don condemn these attacks. The #MakeOurHospitalWork Campaign talk say dis one go worsen di state of health sector for we kontri.
[…] Read tori about di destruction of health facilities for 8 different states for we kontri here. […]