Home EndSARS #EndSARS: Telling Your Police Brutality Tori Go Help Mental Healing – Mental...

#EndSARS: Telling Your Police Brutality Tori Go Help Mental Healing – Mental Health Experts

376
0
#EndSARS

No be tori again say di vex inside di bodi of young people for obodo Naija don enter next level. As #EndSARS we-no-go-gree waka dey continue for every part of we kontri, medical sabi people talk say families wey be victims of police badness go dey undergo “moderate to severe mental trauma” wey mean say pains plenty for dem head.

Some mental health experts wey follow us talk advise people wey di banned Special Anti-Robbery Squad of di Naija Police (SARS) or other bad police people bin kill to use dis opportunity tell dia tori to di world. Dis telling of tori go pepper dem as dem go cry but e go give dem relief later. E fit also help dem get justice and make dem mentally healthier. Dem also advise government to make sure say dem keep dia promise of punishing all bad police people as e go help make di victims and dem families feel better and healthier.

If you or anybody you know wan yan tori as di SARS badness affect dem health, abeg grin grin us for 07088730488 or email talk@talkealth9ja.com.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.