Di Ogbonge government don yan all ogas of federal hospitals make dem make sure say every patient wey come with medical emergency get treatment whether moni dey im pocket to pay deposit or not. Dis order dey for di statement wey di Ogbonge Ministry of Health komot today and signed by di Perm Sec of Ogbonge Bodi-mata Minister, A.M Abdullahi.
Without this directive sef, Section 20 of National Health Act 2014 make am compulsory for health care providers to dey treat every emergency with or without deposit to save life first.
E go pure if all state governors do same thing. See di ministry message.
