Home EndSARS #EndSARS: Lagoon Hospitals Apapa Shut Down as Thugs Attack Am Over False...

#EndSARS: Lagoon Hospitals Apapa Shut Down as Thugs Attack Am Over False Informate!

564
0
Lagoon Hospitals Apapa, Lagos

E be like say Lagoon Hospital don fall victim of di #EndSARS kasala wey dey we kontri as their Apapa hospital don shut down. We hear say some people use vex attack am yesterday evening because of false informate say dem no gree treat pesin till di pesin die.

But di management of di hospital talk say no be true, say dem dey always save life in emergency before dem ask for moni. Say Okada man bring dead pesin to di hospital and when dem tell am say im don kpai, he carry di dead bodi go keep in front of dem gate.

See as di oga of di hospital, Dr Jimi Coker take talk am for press tori.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.