Ogbonge medical doctor and public health expert, Dr. Laz Eze don beg Naija youths say make dem no attack any hospital even as vexation full everywhere for we kontri. He talk dis one for twitter as im dey react to di attack wey force di closing of Lagoon Hospitals yesterday.
Dr Eze wey be di Convener of #MakeOurHospitalWork Campaign talk say anyone wey attack hospital or any health facility dey kill plenty people indirectly. This na because di hospital no fit save lives again especially dis period wey plenty people dey get gunshot injuries.