Home Covid 19 Return to Work! We dey Follow Due Process to Keep Our Agreement...

Return to Work! We dey Follow Due Process to Keep Our Agreement – Health Minister yan Resident Doctors

499
0
Dr Osagie Ehanire: Naija Bodi-mata Minister

Di Oga Minister for bodi-mata, Dr. Osagie Ehanire don call on resident doctors wey dey on strike make dem return to work and “engage” ogbonge government as government dey follow due process to keep di agreement dem sign with doctors. Di Minister talk dis one for di statement wey im komot today.

Di Minister squeeze face because of di strike say e don too much. He talk say doctors suppose remember that their number one job na to save lives. Say dem suppose join hand with government dey fight Coro together for we kontri. He come tell Chief Medical Directors for federal teaching hospitals and Federal Medical Centers to appoint locum or NYSC doctors to help consultants make sure say treatment of patients no stop.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.